IslamPidgin
Peace and blessings upon the Noble Prophet Muhammad, his household, his companions and all those who follow their footsteps till the Day of judgement.
Allah dey use every difficulty wey person face take purify di person sin
عَنْ أَبِي سَعِيدٍ الْخُدْرِيِّ، وَعَنْ أَبِي هُرَيْرَةَ، عَنِ النَّبِيِّ صلى الله عليه وسلم قَالَ
Abu Sa'eed Al-Khudri and Abu Huraira tok say:
The Prophet (ﷺ) come tok say,
مَا يُصِيبُ الْمُسْلِمَ مِنْ نَصَبٍ وَلاَ وَصَبٍ وَلاَ هَمٍّ وَلاَ حُزْنٍ وَلاَ أَذًى وَلاَ غَمٍّ حَتَّى الشَّوْكَةِ يُشَاكُهَا، إِلاَّ كَفَّرَ اللَّهُ بِهَا مِنْ خَطَايَاهُ".
"Any wahala wey jam Muslim—whether na stress, sickness, sorrow, sadness, pain, or serious problem—even if na small shokoshoko wey chook am, Allah go use am clean some of the person sins."
Reference: Sahih al-Bukhari 5641, 5642
Dat mean say, anytime wey Muslim dey go through suffer, whether e big or e small, Allah go take am remove some of di bad wey e don do before. Even di small pain wey e feel, Allah no go let am waste. Allah dey use every difficulty wey person face take purify di person sin, so dat e go get better reward for Hereafter.
