Hold Allah tight kakaranka, you go see say E go dey your front. If you sabi Allah when life soft, E go stand for you when yawa gas

Hold Allah tight kakaranka, you go see say E go dey your front. If you sabi Allah when life soft, E go stand for you when yawa gas

Hold Allah tight kakaranka, you go see say E go dey your front. If you sabi Allah when life soft, E go stand for you when yawa gas.

عَنْ عَبْدِ اللَّهِ بْنِ عَبَّاسٍ رَضِيَ اللَّهُ عَنْهُمَا قَالَ:
Abu Abbaas Abdullah wey bi di pikin Abbaas, who con bi di pikin of Abd Al-Muttalib tok say:
"كُنْت خَلْفَ رَسُولِ اللَّهِ صلى الله عليه و سلم يَوْمًا، فَقَالَ:
One day, I dey for di back of di Prophet peace de upon am, as we dey ride di same animal, e come look me tok say:

يَا غُلَامِ! إنِّي أُعَلِّمُك كَلِمَاتٍ: احْفَظْ اللَّهَ يَحْفَظْك، احْفَظْ اللَّهَ تَجِدْهُ تُجَاهَك
"My pikin, I go run you some beta tok: Hold Allah well kakaranka, e go hold you well. Know Allah, you go see say E go always dey your front.
إذَا سَأَلْت فَاسْأَلْ اللَّهَ، وَإِذَا اسْتَعَنْت فَاسْتَعِنْ بِاَللَّهِ
If you wan ask for somtin, make e be say na Allah you dey ask. If you need help, na only Allah you go call.
وَاعْلَمْ أَنَّ الْأُمَّةَ لَوْ اجْتَمَعَتْ عَلَى أَنْ يَنْفَعُوك بِشَيْءٍ لَمْ يَنْفَعُوك إلَّا بِشَيْءٍ قَدْ كَتَبَهُ اللَّهُ لَك
Make you sabi say, even if di whole world gather dey plan to help you, dem no fit do pass wetin Allah don write say go reach you.
وَإِنْ اجْتَمَعُوا عَلَى أَنْ يَضُرُّوك بِشَيْءٍ لَمْ يَضُرُّوك إلَّا بِشَيْءٍ قَدْ كَتَبَهُ اللَّهُ عَلَيْك
And if dem gather dey plan to do you bad, dem no fit touch you if no be wetin Allah don write say go meet you.

رُفِعَتْ الْأَقْلَامُ، وَجَفَّتْ الصُّحُفُ
Di pen wey dem take write destiny don stop, and di ink don dry, and di matter don close."

رَوَاهُ التِّرْمِذِيُّ [رقم:2516] وَقَالَ: حَدِيثٌ حَسَنٌ صَحِيحٌ
Na Imam Tirmidhi nak dis hadith, e talk say di Hadith dey correct well well.

وَفِي رِوَايَةِ غَيْرِ التِّرْمِذِيِّ:
For another version wey no be di one of Tirmidhi, di Prophet still tok say:

"احْفَظْ اللَّهَ تَجِدْهُ أمامك، تَعَرَّفْ إلَى اللَّهِ فِي الرَّخَاءِ يَعْرِفُك فِي الشِّدَّةِ
Hold Allah tight kakaranka, you go see say E go dey your front. If you sabi Allah when life soft, E go stand for you when yawa gas.

وَاعْلَمْ أَنَّ مَا أَخْطَأَك لَمْ يَكُنْ لِيُصِيبَك، وَمَا أَصَابَك لَمْ يَكُنْ لِيُخْطِئَك
Know say, anytin wey no reach you, e no be your own; and anytin wey jam you, e no fit miss you.

وَاعْلَمْ أَنَّ النَّصْرَ مَعَ الصَّبْرِ، وَأَنْ الْفَرَجَ مَعَ الْكَرْبِ، وَأَنَّ مَعَ الْعُسْرِ يُسْرًا
Know say, na patience dey bring victory, and na afta wahala solution dey show, and anytime problem land, ease dey follow am waka."

Abdulwahab Ibn Yusuf Isah

Abdulwahab Yusuf is an Islamic student, writer, and educator committed to spreading the message of Islam in a way that is accessible to all. As the founder of IslamPidgin, he pioneers the use of Nigerian Pidgin English to convey Islamic teachings, making them relatable and easily understood. A graduate from Bayero University, Kano, he majors in Islamic Studies, Linguistics, Education, and Project Management. His diverse academic background enriches his work in teaching, leadership, and communication. He has served in key leadership roles, including Amir (President) of MSSN Ajaokuta and Chairman of its Da’awah Committee, where he organized impactful religious programs. His experience spans teaching, administration, and project management. Abdulwahab has authored works on Islamic knowledge, psychology, education, and linguistics. He is also the translator of Nigeria’s first Pidgin English rendition of the Forty Ahadith of Al-Imam Nawawi. Through IslamPidgin, he strives to bridge the gap between classical Islamic scholarship and everyday language, ensuring that the wisdom of Islam reaches people in a meaningful and transformative way.

Post a Comment

Previous Post Next Post