IslamPidgin.blogspot.com
وَقَضَىٰ رَبُّكَ أَلَّا تَعْبُدُوا إِلَّا إِيَّاهُ وَبِالْوَالِدَيْنِ إِحْسَانًا ۚ إِمَّا يَبْلُغَنَّ عِندَكَ الْكِبَرَ أَحَدُهُمَا أَوْ كِلَاهُمَا فَلَا تَقُل لَّهُمَا أُفٍّ وَلَا تَنْهَرْهُمَا وَقُل لَّهُمَا قَوْلًا كَرِيمًا
Your Lord don command say make una no worship anybody except am alone. And make una dey treat una papa and mama well. If one of dem or the two of dem don reach old age while dem still dey with you, make you no even bone face give dem, or shout for dem. But dey tok to dem with soft and sweet mouth.
[ الإسراء: 23]
