Islam don balance everything

Islam don balance everything

By Abdulwahab Ibn Yusuf Isah IslamPidgin.blogspot.com

Make we no lie give ourselves. di way Islam take balance dis life sweet well well. For Qur'an, Allah tok say:

وَٱبۡتَغِ فِيمَآ ءَاتَىٰكَ ٱللَّهُ ٱلدَّارَ ٱلۡأٓخِرَةَۖ وَلَا تَنسَ نَصِيبَكَ مِنَ ٱلدُّنۡيَاۖ وَأَحۡسِن كَمَآ أَحۡسَنَ ٱللَّهُ إِلَيۡكَۖ وَلَا تَبۡغِ ٱلۡفَسَادَ فِي ٱلۡأَرۡضِۖ إِنَّ ٱللَّهَ لَا يُحِبُّ ٱلۡمُفۡسِدِينَ" 

"And make you dey find di Hereafter (Darul-Aakhirah) with wetin Allah don give you. And No forget your portion of enjoyment for dis world. And make you de do good just as Allah don do good to you. And no dey find reason to cause fasaad (corruption/spoiling) for dis earth, because na correct truth say Allah no dey like people wey dey do fasaad (mischief/spoil things)".
(Surah Al-Qasas 28:77).

This verse dey show say Islam no tell us make we run comot from dunya. Instead, make we use am take do better thing wey go help us enter Jannah. Islam dey encourage make we find halal money, do business, build life, chop better food, wear better cloth, and waka with dignity as long say we no use am forget where we dey go. People like AbdurRahman ibn Awf and Uthman ibn Affaan, dem get money but dem still dey fear Allah and use their money support Islam. Prophet Sulayman sef get big kingdom and plenty wealth but he still serve Allah well. Even our Prophet Muhammad dey do business before Allah call am to be Prophet, and him be person wey people trust for trade.
 
So my people, to get money no be haram, to enjoy life no be sin, as long as na halal way and we no use am forget Aakhirah. Life na journey, dunya na road, but Jannah na destination.

 Make we chop well, wear well, waka well but make we always remember say na Jannah be final home.





Abdulwahab Ibn Yusuf Isah

Abdulwahab Yusuf is an Islamic student, writer, and educator committed to spreading the message of Islam in a way that is accessible to all. As the founder of IslamPidgin, he pioneers the use of Nigerian Pidgin English to convey Islamic teachings, making them relatable and easily understood. A graduate from Bayero University, Kano, he majors in Islamic Studies, Linguistics, Education, and Project Management. His diverse academic background enriches his work in teaching, leadership, and communication. He has served in key leadership roles, including Amir (President) of MSSN Ajaokuta and Chairman of its Da’awah Committee, where he organized impactful religious programs. His experience spans teaching, administration, and project management. Abdulwahab has authored works on Islamic knowledge, psychology, education, and linguistics. He is also the translator of Nigeria’s first Pidgin English rendition of the Forty Ahadith of Al-Imam Nawawi. Through IslamPidgin, he strives to bridge the gap between classical Islamic scholarship and everyday language, ensuring that the wisdom of Islam reaches people in a meaningful and transformative way.

Post a Comment

Previous Post Next Post