IslamPidgin.blogspot.com
Allah dey help any pesin wey dey help e Muslim brother.
عَنْ أَبِي هُرَيْرَةَ قَالَ قَالَ رَسُولُ اللَّهِ صَلَّى اللَّهُ عَلَيْهِ وَسَلَّمَ
Abu Huraira make Allah de please with am, yarn say di Messenger of Allah Peace de upon am tok say:
مَنْ نَفَّسَ عَنْ مُؤْمِنٍ كُرْبَةً مِنْ كُرَبِ الدُّنْيَا نَفَّسَ اللَّهُ عَنْهُ كُرْبَةً مِنْ كُرَبِ يَوْمِ الْقِيَامَةِ
Anybody wey help comot wahala from pesin wey be believer for dis dunya, Allah go help comot wahala from am for di Day of Qiyaamah.
وَمَنْ يَسَّرَ عَلَى مُعْسِرٍ يَسَّرَ اللَّهُ عَلَيْهِ فِي الدُّنْيَا وَالآخِرَةِ
Anybody wey help pesin wey dey inside gbese or dey owe money (debt), Allah go make e own matter soft for dis life and for di Hereafter.
وَمَنْ سَتَرَ مُسْلِمًا سَتَرَهُ اللَّهُ فِي الدُّنْيَا وَالآخِرَةِ
Anybody wey cover another Muslim shame or mistake, Allah go cover e own for dis world and di Hereafter.
وَاللَّهُ فِي عَوْنِ الْعَبْدِ مَا كَانَ الْعَبْدُ فِي عَوْنِ أَخِيهِ
Allah dey help any pesin wey dey help em Muslim brother.
وَمَنْ سَلَكَ طَرِيقًا يَلْتَمِسُ فِيهِ عِلْمًا سَهَّلَ اللَّهُ لَهُ بِهِ طَرِيقًا إِلَى الْجَنَّةِ
Anybody wey waka for road wey e dey go look for knowledge, Allah go open road wey easy for am to enter Jannah.
وَمَا اجْتَمَعَ قَوْمٌ فِي بَيْتٍ مِنْ بُيُوتِ اللَّهِ يَتْلُونَ كِتَابَ اللَّهِ وَيَتَدَارَسُونَهُ بَيْنَهُمْ إِلاَّ نَزَلَتْ عَلَيْهِمُ السَّكِينَةُ
Anytime wey people gather for Allah house, wey dem dey read di Book of Allah and dey learn am together, Allah go send calmness come meet dem,
وَغَشِيَتْهُمُ الرَّحْمَةُ وَحَفَّتْهُمُ الْمَلاَئِكَةُ وَذَكَرَهُمُ اللَّهُ فِيمَنْ عِنْدَهُ
Em mercy go cover dem, and di angels go dey around dem, and Allah go dey call dem give di angels wey dey near am.
وَمَنْ بَطَّأَ بِهِ عَمَلُهُ لَمْ يُسْرِعْ بِهِ نَسَبُهُ
Anybody wey no dey quick do good deed, em family name no go fit make am run go front.
2699 صحيح مسلم
Dis Hadith dey inside Sahih Muslim (2699), for di Book of Dhikr, Du'a, Tawbah, and Istighfar. Na correct hadith according to Imam Muslim.
