IslamPidgin
Na Jibril be dat. E come teach una di religion.
عَنْ عُمَرَ رَضِيَ اللهُ عَنْهُ أَيْضًا قَالَ:
بَيْنَمَا نَحْنُ جُلُوسٌ عِنْدَ رَسُولِ اللَّهِ صلى الله عليه و سلم ذَاتَ يَوْمٍ، إذْ طَلَعَ عَلَيْنَا رَجُلٌ شَدِيدُ بَيَاضِ الثِّيَابِ، شَدِيدُ سَوَادِ الشَّعْرِ، لَا يُرَى عَلَيْهِ أَثَرُ السَّفَرِ، وَلَا يَعْرِفُهُ مِنَّا أَحَدٌ.
Na Umar wey talk say: One day as we siddan with di Messenger of Allah (ﷺ), one man just waka come. E wear cloth wey white well well, e get black hair gan gan, but e no be like person wey don waka journey, and nobody for our side sabi am.
حَتَّى جَلَسَ إلَى النَّبِيِّ صلى الله عليه و سلم . فَأَسْنَدَ رُكْبَتَيْهِ إلَى رُكْبَتَيْهِ، وَوَضَعَ كَفَّيْهِ عَلَى فَخِذَيْهِ، وَقَالَ: يَا مُحَمَّدُ أَخْبِرْنِي عَنْ الْإِسْلَامِ.
Di man waka go near di Prophet (ﷺ), e com siddan for front, put e knee near di Prophet (ﷺ) own, come place e two hand for e own lap. E come talk say: "O Muhammad, abeg tell me wetin be Islam?"
فَقَالَ رَسُولُ اللَّهِ صلى الله عليه و سلم الْإِسْلَامُ أَنْ تَشْهَدَ أَنْ لَا إلَهَ إلَّا اللَّهُ وَأَنَّ مُحَمَّدًا رَسُولُ اللَّهِ، وَتُقِيمَ الصَّلَاةَ، وَتُؤْتِيَ الزَّكَاةَ، وَتَصُومَ رَمَضَانَ، وَتَحُجَّ الْبَيْتَ إنْ اسْتَطَعْت إلَيْهِ سَبِيلًا.
Di Prophet (ﷺ) talk say: "Islam na say make you bear witness say no god dey wey deserve worship except Allah, and say Muhammad na im Messenger (ﷺ); make you pray (Salaah), pay zakah, fast for Ramadan, and do Hajj if you fit go."
قَالَ: صَدَقْت . فَعَجِبْنَا لَهُ يَسْأَلُهُ وَيُصَدِّقُهُ!
Di man talk say: "You don talk true." We com de surprise say na e ask di question, but na e still talk say di Prophet (ﷺ) don talk true!
قَالَ: فَأَخْبِرْنِي عَنْ الْإِيمَانِ.
E con talk again say: "Tell me wetin be Imaan (faith)?"
قَالَ: أَنْ تُؤْمِنَ بِاَللَّهِ وَمَلَائِكَتِهِ وَكُتُبِهِ وَرُسُلِهِ وَالْيَوْمِ الْآخِرِ، وَتُؤْمِنَ بِالْقَدَرِ خَيْرِهِ وَشَرِّهِ.
Di Prophet (ﷺ) talk say: "Imaan na say you believe in Allah, e angels, e Books, e Messengers, di Last Day, and you go believe for destiny (qadar), whether na good or bad."
قَالَ: صَدَقْت.
Di man talk say: "You don talk true."
قَالَ: فَأَخْبِرْنِي عَنْ الْإِحْسَانِ.
E con ask again: "Tell me about Ihsaan?"
قَالَ: أَنْ تَعْبُدَ اللَّهَ كَأَنَّك تَرَاهُ، فَإِنْ لَمْ تَكُنْ تَرَاهُ فَإِنَّهُ يَرَاك.
Di Prophet (ﷺ) talk say: "Ihsaan na make you worship Allah as if you dey see am, because even if you no see am, em dey see you."
قَالَ: فَأَخْبِرْنِي عَنْ السَّاعَةِ.
Di man con ask: "Tell me about di Hour (di Last Day)?"
قَالَ: مَا الْمَسْئُولُ عَنْهَا بِأَعْلَمَ مِنْ السَّائِلِ.
Di Prophet (ﷺ) talk say: "Di person wey dem ask no sabi pass di person wey dey ask di question."
قَالَ: فَأَخْبِرْنِي عَنْ أَمَارَاتِهَا؟
Di man talk say: "Okay, tell me di sign wey go show say di Hour don near?"
قَالَ: أَنْ تَلِدَ الْأَمَةُ رَبَّتَهَا، وَأَنْ تَرَى الْحُفَاةَ الْعُرَاةَ الْعَالَةَ رِعَاءَ الشَّاءِ يَتَطَاوَلُونَ فِي الْبُنْيَانِ.
Di Prophet (ﷺ) talk say: "Na when slave-girl go born e own madam, and when you go see poor people, wey no get shoe, wey no wear cloth, wey dey suffer, wey be shepherds, dey compete with demself to build tall buildings."
ثُمَّ انْطَلَقَ، فَلَبِثْتُ مَلِيًّا، ثُمَّ قَالَ: يَا عُمَرُ أَتَدْرِي مَنْ السَّائِلُ؟
Di man con waka go. After some time, di Prophet (ﷺ) talk say: "O Umar, you sabi who be di person wey dey ask di question?"
قُلْتُ: اللَّهُ وَرَسُولُهُ أَعْلَمُ.
I (Umar) talk say: "Allah and e Messenger (ﷺ) sabi pass us."
قَالَ: فَإِنَّهُ جِبْرِيلُ أَتَاكُمْ يُعَلِّمُكُمْ دِينَكُمْ
Di Prophet (ﷺ) com talk say: "Na Jibril (Gabriel) be dat. E come teach una di religion."
Dis one na Imam Muslim report am.
