Al-Aqeedah Al-Waasitiyyah part 2 in Pidgin English

Al-Aqeedah Al-Waasitiyyah part 2 in Pidgin English

IslamPidgin
Peace and blessings upon the Noble Prophet Muhammad, his household, his companions and all those who follow their footsteps till the Day of judgement.

Al-Aqeedah Al-Waasitiyyah part 2 in Pidgin English 


Ahlus-Sunnah No Dey Compare Allah with Anything

وَلَا يُكَيِّفُونَ، وَلَا يُمَثِّلُونَ صِفَاتِهِ بِصِفَاتِ خَلْقِهِ، لِأَنَّهُ سُبْحَانَهُ لَا سَمِيَّ لَهُ، وَلَا كُفُوءَ لَهُ، وَلَا نِدَّ لَهُ، وَلَا يُقَاسُ بِخَلْقِهِ

Ahlus-Sunnah no dey try to explain how Allah be, and dem no dey compare am with di things wey e create.

 “Allah no get any equal, no get any partner, and no be like anything wey dem create.”


Allah Na di Only One Weh Get di Most Perfect Names

وَهُوَ سُبْحَانَهُ لَا يُعْلَمُ كَيْفَ هُوَ إِلَّا هُوَ، وَلَكِنْ نُؤْمِنُ بِهُ وَبِصِفَاتِهِ وَبِمَا وَصَفَ بِهِ نَفْسَهُ، وَبِمَا وَصَفَهُ بِهِ رَسُولُهُ صَلَّى اللَّهُ عَلَيْهِ وَسَلَّمَ، مِنْ غَيْرِ إِفْرَاطٍ وَلَا تَفْرِيطٍ

Nobody sabi how Allah be except Allah Himself. But we believe everything wey e tok about Himself and everything wey Prophet Muhammad ﷺ tok about am.

 "We no go add or remove anything from wetin Allah tok about Himself."


Di Belief of Ahlus-Sunnah About Allah Attributes

فَإِنَّهُ سُبْحَانَهُ لَيْسَ كَمِثْلِهِ شَيْءٌ فِي جَمِيعِ صِفَاتِهِ، فَهُوَ سَمِيعٌ بَصِيرٌ

Nothing be like Allah at all for all e attributes. But Allah still be di One wey dey hear and see everything.

 "Nothing dey like Allah, but e still get ear and e see everything." (Surah Ash-Shuura 42:11)


Allah No Need Anybody, But Everybody Need Allah

وَهُوَ الْغَنِيُّ عَنْ كُلِّ مَا سِوَاهُ، وَكُلُّ مَا سِوَاهُ مُفْتَقِرٌ إِلَيْهِ

Allah no need anybody, but na everybody need Allah.

"Allah no dey depend on anybody, but everything wey e create need am."

Allah No Dey Sleep, No Dey Tire

وَهُوَ الْقَيُّومُ الَّذِي قَامَ بِنَفْسِهِ، وَيَقُومُ بِهِ كُلُّ شَيْءٍ، لَا تَأْخُذُهُ سِنَةٌ وَلَا نَوْمٌ

Allah na di One wey dey support everything, but e no dey tire or sleep.

 "Allah no dey feel drowsy, e no dey sleep." (Surah Al-Baqarah 2:255 - Ayatul Kursiyy)

Allah Dey Control Everything

وَهُوَ الْعَلِيُّ الْعَظِيمُ، وَهُوَ الْكَبِيرُ الْمُتَعَالِ
Allah na di One wey high pass everything, and e be di greatest.

 "Allah na di most high, na e great pass."

Allah Na di Only One Wey Get True Power

وَهُوَ الْمَلِكُ، وَلَهُ الْحَمْدُ، وَهُوَ عَلَى كُلِّ شَيْءٍ قَدِيرٌ

Allah na di King, all praise belong to am, and e get power over everything.

 "Na Allah be di real King, and everything dey under e control."

Allah Na di Only One Wey Know Everything

وَهُوَ الْعَلِيمُ بِكُلِّ شَيْءٍ، وَهُوَ الْقَدِيرُ عَلَى كُلِّ شَيْءٍ

Allah sabi everything and e fit do anything wey e want.

 "Allah know wetin dey happen for everywhere, and e get power over everything."

Allah Dey See and Hear Everything

وَهُوَ السَّمِيعُ الْبَصِيرُ

Allah na di One wey dey hear and see everything.

 "Nothing fit hide from Allah eye and e ear dey hear everything."


Allah No Be Like Human Being

وَلَيْسَ كَمِثْلِهِ شَيْءٌ وَهُوَ السَّمِيعُ الْبَصِيرُ (الشورى: 11)

Nothing dey like Allah at all, but e still dey hear and e dey see.

 "Allah no be like anything, but e get ear wey dey hear and e get eye wey dey see."

Allah No Dey Forget Anything

وَمَا كَانَ رَبُّكَ نَسِيًّا (مريم: 64)

Allah no fit ever forget anything.

 "Your Lord no be person wey dey forget."

Allah Get Mercy Wey Pass Everybody Own

وَرَحْمَتِي وَسِعَتْ كُلَّ شَيْءٍ (الأعراف: 156)

Allah mercy cover everything.

 "Di mercy of Allah big pass anything wey you fit imagine."


Allah Dey Control di Universe

يُدَبِّرُ الْأَمْرَ مِنَ السَّمَاءِ إِلَى الْأَرْضِ (السجدة: 5)

Allah na di One wey dey control everything from heaven go earth.

"Everything wey dey happen for this world dey under Allah control."

Allah Fit Do Anything

إِنَّ اللَّهَ عَلَى كُلِّ شَيْءٍ قَدِيرٌ (البقرة: 2

Allah get power over everything.

 "Allah fit do anything wey e want, nothing dey hard for am."

Allah No Be Man, E No Get Pikin

لَمْ يَلِدْ وَلَمْ يُولَدْ، وَلَمْ يَكُنْ لَهُ كُفُوًا أَحَدٌ (الإخلاص: 3-4)

Allah no born, dem no born am, and e no get anybody wey be like am.

 "Allah no get pikin, and e no be pikin of anybody."

Allah Dey Answer Prayer

وَقَالَ رَبُّكُمُ ادْعُونِي أَسْتَجِبْ لَكُمْ (غافر: 60)

Allah tok say, ‘Make una pray to Me, I go answer una.’

"If you call Allah, e go answer you."

To be continued In Sha Allah......





Abdulwahab Ibn Yusuf Isah

Abdulwahab Yusuf is an Islamic student, writer, and educator committed to spreading the message of Islam in a way that is accessible to all. As the founder of IslamPidgin, he pioneers the use of Nigerian Pidgin English to convey Islamic teachings, making them relatable and easily understood. A graduate from Bayero University, Kano, he majors in Islamic Studies, Linguistics, Education, and Project Management. His diverse academic background enriches his work in teaching, leadership, and communication. He has served in key leadership roles, including Amir (President) of MSSN Ajaokuta and Chairman of its Da’awah Committee, where he organized impactful religious programs. His experience spans teaching, administration, and project management. Abdulwahab has authored works on Islamic knowledge, psychology, education, and linguistics. He is also the translator of Nigeria’s first Pidgin English rendition of the Forty Ahadith of Al-Imam Nawawi. Through IslamPidgin, he strives to bridge the gap between classical Islamic scholarship and everyday language, ensuring that the wisdom of Islam reaches people in a meaningful and transformative way.

Post a Comment

Previous Post Next Post