IslamPidgin
Peace and blessings upon the Noble Prophet Muhammad, his household, his companions and all those who follow their footsteps till the Day of judgement.
"Angels Dey Find Where Dem Dey Remember Allah"
عَنْ أَبِي هُرَيْرَةَ رَضِيَ اللَّهُ عَنْهُ، عَنْ النَّبِيِّ صَلَّى اللَّهُ عَلَيْهِ وَسَلَّمَ قَالَ:
Abu Hurayrah don yarn say di Prophet (ﷺ) tok say:
إِنَّ لِلَّهِ تَبَارَكَ وَتَعَالَى مَلَائِكَةً سَيَّارَةً فُضُلًا، يَتَتَبَّعُونَ مَجَالِسَ الذِّكْرِ
Allah (wey get all di glory and honor) get some kind special angels wey no dey stay one place, dem just dey waka up and down dey find where people dey remember Allah name.
فَإِذَا وَجَدُوا مَجْلِسًا فِيهِ ذِكْرٌ، قَعَدُوا مَعَهُمْ، وَحَفَّ بَعْضُهُمْ بَعْضًا بِأَجْنِحَتِهِمْ، حَتَّى يَمْلَأُوا مَا بَيْنَهُمْ وَبَيْنَ السَّمَاءِ الدُّنْيَا
Anytime dem see gathering wey people dey call Allah, dem go siddan join dem, use dia wings wrap demsef round di people, fill di space reach di sky.
فَإِذَااْنْصَرَفُوا عَرَجُوا وَصَعِدُوا إِلَى السَّمَاءِ
When di gathering finish, di angels go rise waka go back heaven.
قَالَ: فَيَسْأَلُهُمْ اللَّهُ عَزَّ وَجَلَّ وَهُوَ أَعْلَمُ بِهِمْ: مِنْ أَيْنَ جِئْتُمْ؟
Di Prophet (ﷺ) tok say: Allah (wey get all power and majesty) go ask dem—even though e sabi beta pass—Wetin be una waka come from?’
فَيَقُولُونَ: جِئْنَا مِنْ عِنْدِ عِبَادٍ لَكَ فِي الْأَرْضِ، يُسَبِّحُونَكَ وَيُكَبِّرُونَكَ وَيُهَلِّلُونَكَ وَيَحْمَدُونَكَ وَيَسْأَلُونَكَ
Dem go tok say: ‘We just waka comot from your servants wey dey this earth. Dem dey yan You (Subhana llah), dem dey hail You (Allahu Akbar), dem dey confirm say na only You be di real God (La ilaha illa llah), dem dey thank You (Al-Hamdu lillah), and dem dey ask You for blessing.’
قَالَ: وَمَا يَسْأَلُونِي؟
Allah go tok: ‘Wetin dem dey ask Me for?’
قَالُوا يَسْأَلُونَكَ جَنَّتَكَ
Dem go com answer: ‘Dem dey beg You make You give dem Your Paradise.’
قَالَ: وَهَلْ رَأَوْا جَنَّتِي؟
Allah go ask dem: ‘Dem don see My Paradise before?’
قَالُوا: لَا أَيْ رَبِّ
Dem go tok: ‘No, O Allah’
قَالَ: فَكَيْفَ لَوْ رَأَوْا جَنَّتِي!
Allah go tok: ‘If dem see My Paradise, how e for be?’
قَالُوا: وَيَسْتَجِيرُونَكَ
Dem go tok say: ‘Dem dey beg You make You save dem.’
قَالَ: وَمِمَّ يَسْتَجِيرُونَي؟
Allah go ask: ‘Wetin dem dey beg Me make I save dem from?’
قَالُوا: مِنْ نَارِكَ يَا رَبِّ
Dem go reply: ‘From Your Hellfire, O Allah.’
قَالَ: وَهَلْ رَأَوْا نَارِي؟
Allah go ask: ‘Dem don see My Hellfire before?’
قَالُوا: لَا
Dem go tok: ‘No.’
قَالَ: فَكَيْفَ لَوْ رَأَوْا نَارِي!
Allah go tol: ‘If dem see My Hellfire, how e for be?’
قَالُوا: وَيَسْتَغْفِرُونَكَ
Dem go tok: ‘Dem dey beg You for forgiveness.’
فَيَقُولُ: قَدْ غَفَرْتُ لَهُمْ، وأَعْطَيْتُهُمْ مَا سَأَلُوا، وَأَجَرْتُهُمْ مِمَّا اسْتَجَارُوا
Di Prophet (ﷺ) tok say: Then Allah go tok: ‘I don forgive dem, I don give dem wetin dem dey ask for, and I don protect dem from wetin dem dey run from.’
يَقُولُونَ: رَبِّ فِيهِمْ فُلَانٌ، عَبْدٌ خَطَّاءٌ إِنَّمَا مَرَّ فَجَلَسَ مَعَهُمْ
Dem go tok: ‘O Allah, among dem get one person wey no too dey righteous, e just waka pass, see dem, come sidan join dem.’
فَيَقُولُ: وَلَهُ غَفَرْتُ؛ هُمْ الْقَوْمُ، لَا يَشْقَى بِهِمْ جَلِيسُهُمْ
Allah go tok: ‘I don forgive am too! Anybody wey siddan with dis kind people no go suffer wahala.’
رواه مسلم وكذلك البخاري والترمذي والنسائي
Dis hadith na Imam Muslim report am, and na Bukhari, Tirmidhi, and Nasaa’i still carry am put for dia books.