Beta Tins Wey Dey inside Taraweeh Prayer

Beta Tins Wey Dey inside Taraweeh Prayer

IslamPidgin
Peace and blessings upon the Noble Prophet Muhammad, his household, his companions and all those who follow their footsteps till the Day of judgement.

Beta Tins Wey Dey inside Taraweeh Prayer


E get plenty better tin wey dey for person wey dey do Taraweeh prayer for Ramadan time:

1- Taraweeh na one of di best ibaadah wey go make person near Allah well well, e still be way wey person fit take get im sin dem forgiven.

Abu Hurairah (may Allah be pleased with him) tok say di Messenger of Allah peace be upon him dey encourage people make dem pray Taraweeh for night during Ramadan, but e no make am compulsory for dem. E, peace be upon him tok say, “Anybody wey pray Taraweeh for night during Ramadan, wit imaan and hope say Allah go reward am, Allah go forgive im past sin dem.”
(Sahih Muslim)

2- To do Taraweeh na way to make di Sunnah of di Prophet peace be upon him to  dey alive.

3- If person pray Taraweeh wit di Imam, until di Imam finish, e go be like say di person don stand for prayer for whole night (qiyam Al-layl).

Prophet Muhammad peace be upon him tok say: “Anybody wey stand wit di Imam until e finish, e be like say e don pray for whole night.”
(Sunan Ibn Majah)

4- Laylat Al-Qadr wey be special night dey inside di last ten nights of Ramadan.

Muslim suppose try well well do plenty ibaadah for di last ten nights of Ramadan, because na inside dem Laylat Al-Qadr dey. Almighty Allah tok say:

“Di Night of Decree beta pass one thousand months.”
(Al-Qadr 97:3)

If person stand for prayer dat night, e go get big reward. Di Prophet peace be upon him even tok say: “Anybody wey do qiyam for Laylat Al-Qadr wit imaan and hope say Allah go reward am, Allah go forgive im past sin dem.”
(Dis Hadith dey inside Sahih Al-Bukhari and Sahih Muslim)



Abdulwahab Ibn Yusuf Isah

Abdulwahab Yusuf is an Islamic student, writer, and educator committed to spreading the message of Islam in a way that is accessible to all. As the founder of IslamPidgin, he pioneers the use of Nigerian Pidgin English to convey Islamic teachings, making them relatable and easily understood. A graduate from Bayero University, Kano, he majors in Islamic Studies, Linguistics, Education, and Project Management. His diverse academic background enriches his work in teaching, leadership, and communication. He has served in key leadership roles, including Amir (President) of MSSN Ajaokuta and Chairman of its Da’awah Committee, where he organized impactful religious programs. His experience spans teaching, administration, and project management. Abdulwahab has authored works on Islamic knowledge, psychology, education, and linguistics. He is also the translator of Nigeria’s first Pidgin English rendition of the Forty Ahadith of Al-Imam Nawawi. Through IslamPidgin, he strives to bridge the gap between classical Islamic scholarship and everyday language, ensuring that the wisdom of Islam reaches people in a meaningful and transformative way.

Post a Comment

Previous Post Next Post